Imam Abubakar Abdullahi. The Muslim leader who risk his life to save some christians from bandits


Remember Imam Abubakar Abdullahi, di Muslim religious leader wey risk im own life to save some Christians wey bandits bin wan kill for Plateau state for 2018?

President Muhammadu Buhari on Tuesday honour di Imam wit Member of the Order of the Niger (MON) award for im heroic act.


Di 83 year old na di Chief Imam of one mosque for Yelwan Gindi Akwati village, Barkin Ladi Local Government Area of Plateau State.

Di Imam save di life of 262 Christians wen dem dey try escape bandits attack for Yelwan Gindi Akwati, Swei and Nghar villages.

Abubakar Abdullahi hide di Berom Christians for im mosque and im his house.

Comments